Eid Kabir na one festive time wey I dey always love, why not? Dat joy wey you dey feel wen you meet your far-far family, friends, and relatives no get part two. Abi na di plenty beef and surplus drinks? Nobody fit miss dis kind adventure o.After my ECN 202 test for Ogba Femi, I just waka go garage sharp-sharp to catch motor go Ibadan. In less dan 10 minutes, di motor don full. You know why? Other people sef dey excited to go house.From garage, pass OUI, Gbongan, Ikire, na so I land for Ibadan (dat city wey get brown roofs). I reach Iwo Road where Micra drivers no gree let trailers move. Even Maruwa, dat three-wheeler, dey try overtake bus. Iwo Road underbridge no be am at all, di place too crowdy. Buyers and sellers don divide di road into two, leave half for trailers, interstate buses, Micra drivers, Keke Napep, and okada to share.You know say dat place no get traffic light or anybody to control di motor dem. But las-las, I see cab wey carry me go Challenge. Normal-normal,...
Comments
Post a Comment